Make Wi Praiz God
David Song
1All of una wey bi God savant and doz wey dey serve for God temple for nite,
make una praiz God.
2Make una raiz una hand for di temple
kon praiz God!
3Make God wey kreate heaven
and eart bless una from Zion!