Make God Glory Kover Di Eart
David Prayer Wen E Dey Run From Saul
1My God, make Yu sorry for mi.
Abeg, sorry for mi,
bikos na Yu dey protet mi.
I go hide under yor shadow
until I don free from all dis wahala.
2I kry to di Most High;
di God wey dey supply evritin wey I wont
3and E go send help kom from heaven kon save mi,
den disgrace doz wey won kill mi.
My God go send en goodness
and love wey nor dey fail kom.
4Na lions gada round mi so!
I dey with pipol wey won kill mi;
pipol wey dia tit sharp like spear and arrow
and wey dia words dey kut like swods.
5My God, make Yu raiz pass di sky!
Make yor glory shine for evriwhere for di eart.
6My enemies don set trap for mi
and I don taya bikos of dia wahala.
Dem dig deep pit for where I dey waka pass,
but na dem go fall enter by demsef.
7My God, I get hope.
Yes! I get hope.
So I go sing kon praiz yor name.
8So, make my heart wake-up!
Trumpet and jita, make una wake-up too!
Mi mysef go wake-up for morning with song for my mout.
9I go tank Yu wey bi my God for where evribody dey.
I go sing yor praiz among all di nashons.
10Bikos yor love wey nor dey fail, high pass heaven.
Yor faithfulnes dey rish di kloud.
11My God, make Yu raiz pass di sky
and make yor glory shine kon kover di whole eart.