Na God Bi Judge
Asaf Song For Di Kwayamasta
1My God, wi tank Yu!
Wi dey tank Yu bikos Yu dey near us
and pipol for evriwhere dey tok
about di wonderful tins wey Yu dey do.
2God sey, “Wen di time wey I choose don rish,
I go judge pipol.
3Di eart go shake and evribody go fear,
bikos na mi make di foundashon.
4I don warn proud pipol sey, ‘Make dem stop to dey make mout!’
kon tell wiked pipol sey, ‘Make una nor dey happy sey una don win!
5Make una nor tink sey una don win di fight
or karry body up wen una dey tok.’ ”
6Viktory nor dey kom from east or west
or from di wildaness,
7bikos na God dey judge!
E dey bring one pesin down and karry anoda pesin up.
8One cup wey full with wine wey dem mix with spice,
dey for God hand and E pour am for di world.
True-true, all di wiked pipol for di world
go drink from am till e finish.
9But for mi, I go always dey tok about wetin Yu don do;
I go sing and praiz Jakob God!
10God sey, “I go distroy wiked pipol with dia pawa
kon give viktory to pipol wey dey fear mi.”