Job Still Dey Tok
1Job still sey:
2“If to sey my life go fit bi as e bi before
wen God dey look and guide mi!
3Dat time, God always dey with mi
and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness.
4Dat na di time wey evritin still dey well with mi.
Den God goodness still dey protet my house.
5Den God still dey with mi
and all my shidren gada round mi.
6My melu and goats dey give mi plenty milk
and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.
7Wen ever di town eldas dey meet
and I go der,
8yong boys dey stand as soon as dem si mi dey kom
and old pipol dey stand greet mi with respet.
9Di leaders wey dey lead di pipol
go stop to tok.
10Even di pesin wey dey important pass,
go shut up for mi.
Job Dey Good Well-well
11“Evribody wey hear from mi, dey praiz mi.
Doz wey hear mi dey tok, go-go tok good about mi.
12Wen poor pipol kry kom meet mi,
I dey help dem;
I dey help pikin wey nor get papa
and mama and doz wey nor get where to go.
13Doz wey dey face wahala, dey praiz mi
and I dey protet and guide wimen wey dia husband don die.
14I dey always do betta tin.
Evritin wey I do dey always dey good.
15Na mi bi blind pipol eye
and doz wey nor fit waka,
na mi bi dia leg.
16I bi like papa to poor pipol
and I dey setol matter even for doz wey I nor know.
17I dey distroy wiked pipol pawa
kon release di pesin wey dem katch.
Job Get Mind
18“Den I sey, I go get long life
kon die for my house without trobol.
19I go bi like tree wey en rut get wota;
wey dew dey wet en branches.
20Evribody go dey praiz mi
and my pawa nor go fail.
Job Good Karata
21“Wen I dey advise pipol,
dem dey kwayet listin to wetin I dey tok
22and dem nor dey get anytin to tok wen I don tok finish.
My word dey enter dia mind well.
23Evribody dey welkom mi,
just as farmer dey welkom rain wey won fall.
24I dey smile give dem wey nor bilive diasef again
and my betta face dey give dem hope.
25I dey lead dem as king dey lead many pipol
kon konfort dem wen dem dey face trobol.