Wisdom
1Job sey,
“Where dem for dey dig silva, na der precious stones dey
and e still get where dem for dey rifine gold too.
2Na from groun dem for dey dig iron
and melt koppa.
3Man don end darkness,
bikos dem shine lite dey search under di eart
and dey dig rock wey dey for darkness.
4Where dem for dig di precious stones
dey far from where pipol dey stay
and nobody dey travel pass der again.
Dem dey stagga fall
and pipol nor dey der.
5Even doh food dey kom from di eart,
evriwhere under di eart,
don skata like wetin fire burn.
6Na betta stone dey di eart
and gold dey en dust.
7No bird know di road wey lead to where gold dey
and know vulture don fly pass or si am before.
8No lion or oda wiked animals fit travel
pass dat road wons.
9Pipol dig di rock and mountins wey hard pass
bikos dem dey find gold.
10As dem dey dig hold for di rock,
dem kom si precious stones.
11Dem dig rish wota kon bring wetin dem hide,
kom out for lite.
No Money Fit Buy Wisdom
12“But where wi go fit si wisdom?
Where wi go fit learn how to undastand?
13Yu nor fit si wisdom with human being;
bikos e nor dey among pipol wey dey alive.
14Even bottom river sey,
‘E nor dey with mi’
and under sea sey,
‘E nor dey with mi too.’
15Dem nor go fit buy wisdom
with gold or silva.
16Di gold and jewel wey fine pass
nor get value rish wisdom.
17Wisdom dey more important pass gold;
e even dear pass where gold full or where fine glass dey.
18Wisdom get betta value pass diamond
or fine glass.
19Topaz stone wey fine pass and di gold wey klean pass,
dem nor fit kompare dem with wisdom.
Na Only God Get Wisdom
20“But where wisdom from kom sef?
Where wi go for fit learn how to undastand?
21Nor-tin wey dey live for dis life fit si wisdom,
even di birds wey dey fly nor fit si am.
22Deat and distroshon agri sey,
na hear dem just dey hear.
23Na only God know di way
and place where dem fit si wisdom,
24bikos E dey si di end for di eart
and E dey si evritin wey dey under di sky.
25Na God give breeze pawa
kon measure where di sea go rish.
26Na God dey choose where di rain go fall rish
and where tonda go travel pass.
27Na der E si wisdom kon test as e important rish,
den E si sey e dey good.
28God tell human being,
‘Before una go get sense, una must woship mi.
Una go turn live bad tins,
before una go fit get undastandin.’ ”