Mikaya And Israel Leaders
1I sey,
“Una wey bi leaders for Israel,
make una listin!
Na una suppose know good from bad,
2but na una even hate good tins
kon love wiked tins.
Una dey kill my pipol alive
kon kut dia flesh from dia bone.
3Yes! Una dey chop my pipol flesh,
remove dia skin kon break dia bones.
Una dey kut dem small-small
like meat inside pot.
4But wen una dey trobol,
una go kom beg God make E help una!
Una dey espect sey God go ansa una?
Afta all di wiked tins wey una don do,
God nor go even look una face!”
5Dis na wetin God tok:
“Una wey bi lie-lie profets dey make my pipol sin!
If pesin give una food chop,
una go sey make peace dey with am,
but doz wey nor give una,
una go won fight dem.
6So, na only darkness una go dey si
and una nor go get any vishon.
Darkness go kover una
kon end evry hope wey una get.
Sun nor go shine for una profets head again a
nd una life go end like dat.
7Den shame and disgrace go follow una pipol
wey dey si vishon.
Una go kover una face,
bikos God nor go ansa una.”
8But na God pawa and spirit dey my body.
E give mi sense to judge well
with strent to take tell Israel pipol about dia sin.
9Una wey bi leaders for Israel,
make una listin to mi!
Una hate to judge well
and dey shange evritin wey dey rite.
10Na blood and sin bi di foundashon
wey una build Jerusalem put.
11Una leaders nor dey judge well,
bikos dem don take bribe
and una priest dem dey do dia work,
bikos of money.
Una profets nor dey profesai
unless dem first pay dem.
Yet all of una sey una trust God.
Una sey,
“Nor-tin go happen to us,
bikos God dey with us.”
12So, bikos of una,
I go klear Zion like field;
Jerusalem go bi where dem dey trowey dirty put
and di temple go turn hill wey grass grow kover.