Sorrow Song
1God sey make I sing dis sorrowful song for di prince dem wey dey Israel:
2“Una mama na really strong lion
wey train en shidren
for where oda wiked lions dey.
3E tish one among en shidren
how e go take katch oda animals
and naw, e dey chop human being.
4But pipol for oda nashons hear about am,
so dem tie and trow am inside pit
kon drag am with hook go Egypt.
5Wen di mama wait kon si sey en pikin
nor dey kom back again,
e kon train anoda lion
wey wiked pass di first one.
6Wen dat one don big,
e kon start to katch animals
and chop human being like oda lions.
7E skata where sojas dey guide well
and distroy dia towns.
Di way e dey shaut,
dey make di pipol for di land dey fear.
8Pipol gada kom from evriwhere
kon fight am.
Dem spread dia net
kon katch am with dia trap.
9Den dem put am for kage
kon karry am go give Babilon king.
Dem put am for prison,
so dat pipol nor go hear en vois again
on-top Israel mountin.
10Yor mama bi like vine wey dem plant near wota
wey get fresh leaf and dey bear good fruits.
11En branches strong well-well like royal rod.
Di vine grow and tall well-well.
Yes! Evribody si as e tall rish
and how en leaf fine.
12But wiked pipol kon kut am down.
Di wind blow kon dry all en fruit.
En branches dem break komot
kon dry and fire burn dem.
13Naw, dem plant am for desert;
di place wey dry and nor get wota.
14Den fire katch di vine
kon burn evritin
plus en fruit finish
and e nor go ever strong again.
E nor go ever bi dat royal rod again.
“Dis na di sorrowful song wey dem go always dey sing.”