32
Moses Song 
 1 Heavens make una listin to mi as I dey tok; 
eart make una listin to di words wey I won tok so. 
 2 Make wetin I dey tish una, fall on-top una like rain; 
make wetin I dey tok bi like dew for morning. 
Make my words fall like rain on-top grass 
and make e bi like shawa on-top plant wey just dey grow. 
 3 Bikos I go tok about God name 
and how E dey strong! 
 4 Na-im bi di Rock; 
evritin wey E dey do dey korrect, 
bikos wayo nor dey en tins. 
En na God wey pesin fit bilive, 
bikos E nor just dey judge pipol anyhow. 
 5 En pipol nor dey respet or fear am; 
dem nor dey bihave like en shidren 
and na dis bi dia sins. 
Dem wiked well-well 
and na lie-lie full dia generashon. 
 6 Dis pipol wey nor get sense at-all, 
na like dis una won take pay God? 
Nor bi en bi una papa wey kreate una? 
Na-im kreate and make una strong. 
 7 Make una remember as e bi before, 
make una tink about di generashon wey don pass. 
Make una ask una papa and una eldas 
and dem go tell una evritin. 
 8 Wen di God of all ogas give di nashons dia propaty; 
wen E divide evry human being, 
E give di pipol where dem go stay rish, 
akordin to di nomba wey dey for heaven. 
 9 Na God get di pipol for Israel; 
na Jakob bi en special propaty. 
 10 Na empty dirty land for wildaness E for si dem. 
E dey look and guide dem for evry korna; 
E dey guide dem as pipol wey E love well-well. 
 11 Just as di eagle dey wosh en house 
kon kover en shidren, 
na so too God spread en feada 
kon karry dem go up. 
 12 Na God dey guide dem by ensef, 
e nor get any oda god wey dey with am. 
 13 E allow dem travel pass di high place for di land 
kon chop from di plants wey dey di field. 
E use honey from di rock 
and olive oil from strong groun take kare for dem. 
 14 E feed dem with milk from di animals 
and with di fats wey dey lamb body. 
E give dem betta ram and goat form Bashan, 
plus fine-fine food. 
Una don drink di wine 
wey sweet pass wey dem make from grape. 
Israel Sin 
 15 But Israel pipol kon fat and wiked more-more. 
Di pipol kon heavy, round and tick for body! 
Dem forget God wey kreate dem; 
den kon rijet di Rock wey bi dia salvashon. 
 16 Dem make am jealous, 
bikos dem dey serve juju and oda gods. 
 17 Instead make dem sakrifice give God, 
dem dey sakrifice give juju 
and gods wey dem nor know; 
new gods wey dem just si, 
even gods wey dia grand-grand papa 
dem nor know about. 
 18 Dem don forget di Rock wey bi dia papa 
and di God wey kreate dem, nor dey dia mind again. 
Judgement 
 19 So wen God si all dis tins, 
E vex bikos en shidren dey disobey am. 
 20 God sey, “I go rijet dem, 
I go si wetin go happen to dem; 
bikos dis generashon dey show sey dem too know 
and dem nor get sense. 
 21 Dem don make mi dey vex 
for di gods wey dem dey serve; 
dem don make mi dey vex well-well 
with tins wey nor mean anytin: 
So, I go make dem jealous doz wey nor bi human being: 
I go make dem vex well-well for kountry wey nor get sense. 
 22 Bikos my vexnashon don kause fire 
and e don burn rish di part wey deep pass for di grave 
kon distroy di eart and en plants, 
den e skata di mountins foundashon. 
 23 I go inkrease dia wahala, 
I go use all my arrow for dia body. 
 24 Honga go kill dem, 
betta sofa go worry dem. 
I go send wiked animal 
and bad snakes go chop dem. 
 25 Di swod go bring deat for outside and for inside, 
fear go kill both men and wimen; 
small pikin and di ones wey don big. 
Oda Gods Nor Get Pawa 
 26 “I sey, ‘I won kut dem to pieces. 
I won make pipol forget dem forever. 
 27 But I nor go like how di enemies go si am, 
bikos dem nor go undastand 
and dem go sey, wi too get pawa 
and nor bi God do all dis tins!’ ” 
 28 Dem bi pipol wey nor get sense 
and dem nor fit undastand at-all. 
 29 How I wish sey dem get sense and fit undastand dis tins 
or know wetin go happen to dem. 
 30 How one pesin go fit porshu 1,000 among dem 
and two pipol porshu 10,000; 
if nor bi sey dia Rock sell dem 
and dia God give dem to dia enemies? 
 31 Bikos awa enemies rock nor bi like awa Rock 
and even awa enemies know sey na so e bi. 
 32 Dia vine na from Sodom and Gomorrah field. 
Dia grape get poizin and e bitter well-well. 
 33 Dia wine na snake poizin 
and e bad like kobra own. 
 34 God sey, “I nor dey keep all dis tins 
among di tins wey I value? 
 35 I go revensh and pay dem back wen dem go fall, 
bikos di day wen wahala go kom meet dem, 
don near well-well 
and dia judgement don almost full!” 
 36 God go judge en pipol 
and E go shange en plan about en savant; 
wen E si sey dia pawa don vanish 
and nobody remain again, 
weda na slave or free pesin. 
 37 E go sey, “Where una gods, 
di rock wey una bilive sey, e go guide una, 
 38 wey dey chop di best for una sakrifice 
kon drink di wine for una drink ofrin? 
Make dem raiz naw kom help una; 
make dem kon save and guide una!” 
God Na God 
 39 God sey, “Na Mi, bi Mi! 
And e nor get any oda god escept Mi. 
I dey kill and give life, 
I dey make pesin sick and heal pesin too 
and nobody go fit fight mi. 
 40 Bikos I raiz my hand go heaven kon sey, 
‘As long as I dey forever, 
 41 I go make my lite sharp like swod 
and my hand go hold di judgement swod well-well; 
I go revensh doz wey make mi vex 
kon pay doz wey hate mi! 
 42 I go make my arrow full with blood 
and my swod go distroy pipol flesh, 
doz pipol wey I katch and kill 
and even di enemies oga blood!’ ” 
 43 My pipol, make una happy, 
bikos God go fight for en savant; 
E go pay en enemies back 
kon sorry for en pipol and dia land. 
Moses Final Word 
 44 Den Moses go with Joshua, Nun pikin kon sing all di word for di song give di pipol.  45 Wen Moses don sing di song give Israel pipol,  46 e kon tell dem, “All dis words wey I dey tell una today, make una keep am for una mind; una must kommand una shidren to obey all dis law and kommand.  47 All dis nor bi ordinary word, but dem dey give life! Wen una obey dis word, una go get long life for di land wey una go soon cross Jordan River enter.” 
About Moses Deat 
 48 Dat same day, God tell Moses,  49 “Make yu go Abarim hill kountry for Mount Nebo (where bi Moab land opposite Jeriko) den look Kanaan land wey I won give Israel pipol as dia own.  50 Yu go die for dat mountin wey yu go klimb kon go join yor grand-grand papa dem, just as Aaron yor broda die on-top Mount Hor kon join en grand-grand papa,  51 bikos di two of una sin against mi for Israel pipol front for Meribah Kadesh wota for Zin wildaness, wen yu nor respet mi as yu suppose to.  52 Yu go si di land, but yu nor go enter di land wey I dey give to Israel pipol.”