Prayer For Trust
David Song
1My God, my heart nor dey proud;
my eyes nor dey look anyhow.
I nor dey worry mysef with matter
wey too heavy for mi to bear.
2Instead, I dey kwayet and dey silent
like pikin wey nor dey kry for breast milk again.
Yes, I kwayet like pikin wey en mama karry.
3So Israel pipol, make una put una hope for God hand,
both naw and forever more!