Na God Dey Protet En Pipol
David Song
1Make Israel pipol sey,
“If to sey Oga God nor dey awa side?”
2If to sey God nor really dey awa side
wen pipol attack us,
3dem for don swallow us
alive as dem dey vex.
4River for don kover us;
wota for don karry us go.
5Strong wave for river
for don kover awa soul.
6So, make wi praiz God
wey nor let awa enemies tear us to pieces with dia tit!
7Wi don eskape like bird
wey komot from hunta trap.
Dia trap and net wey dem set for us,
don break and wi don dey free!
8God wey kreate heaven and eart,
na-im diliver us from dia hand.