Prayer For Di King
David Prayer For Solomon
1My God, I beg Yu! Make Yu give di king di sense to dey judge well!
Always allow di king pikin dey tok wetin dey korrect!
2Den e go judge yor pipol
and doz wey dem dey opress, well.
3Di mountin go karry peace news kom meet yor pipol
and di hills go tok about korrect judgement.
4E go defend doz wey dem dey opress among di pipol,
diliver poor pipol shidren and distroy doz wey dey opress pipol.
5As long as di sun and moon dey di sky,
pipol go always dey fear Yu from one generashon go rish anoda.
6Wen di king dey rule, e go bi like wen rain fall
on-top grass wey dem kut;
e go bi like rain wey dey wota di groun.
7All di pipol wey dey fear God go prosper as di king dey rule.
So make goodness follow dem,
as long as di moon dey shine for di sky.
8Make di king rule from sea go rish sea
and from Eufrates River go rish di end for di eart.
9Desert go bow before am;
en enemies go fall for groun for en front.
10Tarshish kings for west
and di oda kings go kon pay respet to am.
Sheba kings for east and Seba go kon gi-am gifts.
11All di kings go bow for am
and all di nashons go serve am.
12Di King go save poor pipol wen dem kry kom meet am
kon help doz wey dem dey opress
and doz wey nor get who go fight for dem.
13E go pity for doz wey dey weak
and poor kon save dem.
14Bikos dia life dey important to am,
e go save dem from pipol wey dey opress and kause wahala for dem.
15Di king go live forever!
Dem go dey gi-am gold from Sheba
and di pipol go always dey pray and bless am evriday.
16Food go many for di land
and seeds go even dey grow well on-top mountins.
Make trees bear betta fruit like di trees for Lebanon
and make pipol for di land dey grow well
like betta grass for di field.
17Make di king rule forever;
make en kingdom kontinue as long as di sun dey shine.
Make blessing dey all di nashons bikos of am,
so dat dem go praiz am.
18Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God
bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.
19Make una praiz en name wey get glory forever!
Make en glory dey di whole eart.
Amen!
20David wey bi Jesse pikin,
na here en prayers for end.