Men Wikedness
David Song For Di Kwayamasta
1Na fools dey tok for dia heart sey,
“God nor dey.”
Dem don spoil;
na bad tins dem dey do
and e nor get any one among dem wey dey do good!
2God dey from heaven look evribody;
E dey look to si if anybody really get sense
and weda anybody really dey find am.
3But nor bi so. Evribody don dey sin;
evribody don spoil finish.
E nor get anybody wey dey do good at-all!
4Pipol wey dey do wiked tins nor get sense at-all?
Dem dey chop my pipol like bread
and dem nor ever dey tink sey e good make dem pray to God.
5Fear go katch dem
and na di kind fear wey dem neva si or hear before.
God go skata yor enemies bones.
God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.
6Na who go kom from Mount Zion
kon save Israel pipol?
Wen God don save en pipol, den
Jakob shidren go shaut with joy
and Israel pipol go happy well-well.