Di True Woship
1Israel pipol, make una listin to wetin God dey tell una. 2Di Oga una God sey,
“Make una nor do wetin oda nashons dey do;
make una nor let doz signs for sky disturb una mind,
even if oda nashons dey fear am,
3bikos dia relijon dey yuzles.
Dem dey kut wood from forest
kon gi-am to pesin wey dey karve
and e go karve image with di wood;
4use silva and gold take dekorate am
kon nail am make e for nor fall.
5Dat kind juju bi like image for farm
where dem plant melon put.
Di juju nor dey tok;
dem must karry am waka,
bikos e nor get leg.
But make una nor fear dem,
bikos dem nor go fit wound or help una.”
6I sey,
“My God! Nobody bi like Yu.
Yu dey mighty and yor name dey great with pawa.
7E nor get who nor dey fear Yu,
bikos na Yu kreate evritin.
Nobody bi like Yu for di whole world.
Even kings and wise men nor rish Yu.
8Evribody for dis world na fool
and dem nor get sense.
Wetin dem fit learn from juju
wey dem make from wood?
9Na silva and gold from Spain and Ufaz
dem take kover di juju.
Na doz wey sabi karve make am with dia hand
kon dress am with violet and purpol klot wey dem weave.
10But na only Yu Oga,
bi di true God.
Di God wey dey alive
and Yu go rule forever.
Anytime Yu dey vex,
di world dey shake
and nobody fit stand wen Yu dey vex.
11So Israel pipol make una tell di oda nashons sey:
‘Nor bi doz gods make di heavens and di eart.
So dem go disappear komot from di eart and heavens.’
12Na God make di eart with en pawa;
na-im wisdom and undastandin
E take kreate di heavens and eart.
13Wen E kommand,
en vois dey sound like tonda and di wota for heaven
go make nois like lion vois.
E dey make kloud kom out from where di eart for end.
E dey bring tonda lite wen rain dey fall
and E dey make breeze blow
kom from where E keep dem put.
14All dis bad tins kon turn di pipol to fool
and dem nor get sense again.
So, disgrace go follow doz wey dey make juju,
bikos di juju na lie-lie and dem nor get life at-all.
15Di juju dey yuzles,
so make dem distroy dem trowey
and time dey kom
wen God go ponish and distroy all of dem.
16Jakob God nor bi like dem;
na-im kreate evritin
and E don choose Israel as en own pipol.
En name na God wey dey mighty.”
Distroshon Wey Dey Kom
17Jerusalem pipol!
Make una pak una tins!
Make una run komot di land,
bikos una enemies don surround una.
18God sey,
“I go trow una komot for dis land.
Yes! I go kill all of una finish.”
19So I kry,
“Wi don die finish!
Awa own worse well-well o-o!
Wi tink sey wi go fit bear dis one.
20Dem don distroy awa house
and di rope wey bin whole di house togeda,
don kut.
Dem don karry awa shidren go as slave
and dem nor go kom back again,
bikos of dat,
nobody dey to help us build awa house
or hang di curtains again.”
21But I still sey,
“Dat na bikos awa leaders nor get sense.
Dem nor gri go meet God make E tell dem
wetin dem go do.
So dem kon do tins like fools
and all di pipol wey dem dey lead,
don skata finish.
22So make una listin!
One news dey kom naw!
Wahala dey kom from di nashons for nort!
Dia sojas don skata and turn Judah town
to desert where animals dey stay.
23My Oga God,
wi know sey pipol nor fit kontrol dia own destini
and dem nor get di pawa to know
wetin go happen to dem.
24Abeg God,
make Yu korrect wi wey bi yor pipol.
Make Yu nor ponish us
bikos Yu dey vex, if not,
all of us go die finish.
25Make Yu vex well-well
for di nashons wey nor gri woship Yu
and doz wey rijet Yu,
bikos dem don kill and distroy yor pipol finish
kon turn awa land to desert.”